Canada Announces New 2026 Express Entry Categories for International Workers

podiumadmin
57 Views
4 Min Read

Di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) don unveil new categories under di Express Entry system for international workers wey wan come work for di country.

According to IRCC Minister, Lena Metlege Diab e say di announcement of di 2026 express entry categories na to allow Canada invite candidates wey get skills and experience.

Di new categories na Canada way of controlling dia to sustainable levels, as dem go kontinu to dey support dia economy.

Express Entry na Canada flagship application management system for pipo wey dey find how dem go take japa permanently through di Federal Skilled Worker Program, di Federal Skilled Trades Program, di Canadian Experience Class and part of di Provincial Nominee Program.

Inside Canada 2025-2026 Immigration plans, dem dey focus on Express Entry class invite candidates wey get experience to work for Canada so dem go fit apply for permanent residence.

Dem wan keep permanent resident admission for less dan 1% of Canada population annually beyond 2027, but also attract talent international workers.

Canada plan na to reduce di share of temporary residents wey dey Canada to 5% of di population by di end of 2026.

Di new plan don set overall temporary resident targets of 673,650 for 2025, and temporarily set 516,600 target for 2026 and 543,600 for 2027.

Dis new Express Entry categories wey dem announce go provide clear pathways to top international talent wey want permanent residency.

Canada dey seek to invite foreign medical doctors wey get Canadian work experience.

Also, dem introduce new categories for di field of research and senior managers wey also get Canadian experience.

Categories wey include candidates wey get experience for aviation, transportation and foreign military officers, also dey among di new announcement.

IRCC say dem go continue dey select candidates wey get strong French skills and dose wey don get work experience for area of health care and social services.

For Canada, Immigration dey accounts for almost 100% of dia labour force growth, and e dey help dem address labour shortages for important sectors.

According to Canada immigration minister, dem dey work to attract and retain di best talent to dia country.

She add say di Express Entry announcement go help strengthen Canada economic power “through targeted measures for medical doctors, graduate students and researchers, as well as Canada Defence Industrial Strategy.”

Advertisements

Di 2026 Express Entry categories

Canada dey seek top talent wey include:

  • medical doctors, researchers and senior managers wit Canadian work experience
  • workers wit French-language proficiency
  • health care and social services professionals
  • tradespersons
  • educators
  • professionals for science, technology, engineering and mathematics (STEM) occupations
  • professionals for transport occupations
  • pilots, aircraft mechanics and inspectors
  • highly skilled foreign military applicants recruited by di Canadian Armed Forces for key roles such as military doctors, nurses and pilots

For 2025, Canada announce new categories for di express entry draw for workers and also add to di list of occupations wia pipo fit apply to work and permanent residence.

Dat time IRCC say di new category for di 2025 Express Entry draws na to address di shortage of labour skills for Canada economy.

For dat same year 2025, Canada launch four new permanent recidency (PR) pathways even wen dem dey try reduce dia kontri annual immigration targets.

Advertisements

Stay ahead with the latest updates!

Join The Podium Media on WhatsApp for real-time news alerts, breaking stories, and exclusive content delivered straight to your phone. Don’t miss a headline — subscribe now!

Chat with Us on WhatsApp
Share This Article
Leave a Comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *